UNIVERSITY OF NIGERIA COMMUNITY
To Restore The Dignity of Man
Welcome, Guest. Please login or register.
May 23, 2012, 11:49:10 AM
Home AfricaEd.com UNN.EDU.NG PHOTO GALLERY Calendar Login Register


UNIVERSITY OF NIGERIA COMMUNITY | GENERAL COMMUNITY | General Discussions | Jokes | Topic: Jokes Entertainment Cinema!!
Pages: 1 2 [3]   Go Down
Print
Author Topic: Jokes Entertainment Cinema!!  (Read 1441 times)
0 Members and 3 Guests are viewing this topic.
ejibond
It is not by my power. Greatest
Global Moderator
Award Winning Member
*****

Karma: 4
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 2405


ONE LOVE!!


View Profile
« Reply #40 on: November 12, 2010, 16:40:16 PM »

    THE GOLDEN JUBILEE Episode 10

Gago: emm! d goat & fowl don dey find me troble tey tey na im make i put trap 4 dem..

Ak: so,bcos of odinari animal wey no knw anytin find una troble una con bgin dey set dem trap abi? anyway,dat wan na una prblm but make i no find any of my animals atall o..

Headek: aah oga! d goat wey i set trap 4 no b ordinali goat o..e knw sumtin well well but make u no wowi cos notin go hapen to ur own animals dem..

Ak: na u sabi dat wan..ehen maga!....(surprised)..shoo! Maga na wetin hapen to ur nose?...person fight u?

Maga: eemm...eemm!...na goat do am!

Ak: gooaatt do u wetin??..how?

Maga: eemm!...i put fried rice wit fowl meat wey i wan chop 4 outside con go bring water wey i go drink..as i come outside,na im i c goat dey chop my fud..na im i con bendown to catch d goat,d goat con carry im strng head nod me 4 nose con run away...

Ak: wait o! shey na dream dat wan hapen?...cos me no bliv dis ur tori atall oo..

Maga: aah oga na true i yarn o...na 4 real life e hapen...d goat just taget my nose con nod me run...i swear,i go kil d goat if i catch am...

Ak: hmmm! u c dis goat & fowl tori wey u,gago & headek con dey tori me dis mornin no go stop d main tin wey bring us 4 dis meetin...na only d 3 of una sabi wetin una dey talk abt...una hear me so?...oya how far una don go abt our yestaday plan?

Wako: oga,evrytin dey work acording to plan...i don package d gift 4 2 cars

Ak: veli gud...nw headek! hw far? shey u don find out d place wey d parti go hapen?

Headek: yes oga! i don call frug & im tell me say na 4 eagle's square wey dey 4 abuja d main parti go hapen...

Ak: whch means say na for eagle's square we go drop d gift abi?

Headek: na so..

Ak: veli gud...our plan don dey complete but we no get time again...na 2moro b octoba 1st wey d gubili parti go bgin...eemm!..gago and sambo,shey bi una don hearam say na 4 eagle's square wey dey abuja una go drop d package abi?

Gago:Yes oga,we don hearam...

Ak: veli gud...but make una make sure say nobodi...i repeat!,no bodi must notice wetin una carri atall...una hear me so?

Sambo: oga notin do u atall...

Ak: and u too but una must dey veli fast abt d delivery cos d gift get time countdown wey una go take drop d gift 4 d place or else notin do u go bcom somtin do u...hope say una dey dig me so?

Gago: wait o! oga shey u mean say if we no drop am on time, we go bcome suya?

Ak: Gbaamm!!

Gago: chaai ooo..i don die!

To Be Continued.....
Logged

Cleanliness is next to godliness.How clean is ur heart?....clickHERE
mac-blend
Sr. Member
****

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 316


View Profile
« Reply #41 on: November 12, 2010, 17:05:00 PM »

Chai Ejibond,dis ya suspense don too much o! I bin don arrange ma sef kip say d finale of d episode don com. Na im u com kip me 4 anoda section of suspension. If u c how ur man don belle wise 4 okiriko lafta eh! Hmm. Eji make u dey carry dey go. Patiently w8in.
Logged

The reason u can't b me,is simply d reason i can't b u.
machina
Hero Member
*****

Karma: 1
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 601


try God....... believe in yourself.


View Profile
« Reply #42 on: November 12, 2010, 18:46:01 PM »

hey! see o, e be like say gago don understand say na him be the goat o o, see as he they imagine himself becoming suya.  so hadaek go become chicken  & who go come shop who na?
Logged

Any student that has just been addmited into med-lab or any oda dept in health/medical sci.  Who needs my assistance should pm me his no so he wil mine. U'r all welcom.
machina
Hero Member
*****

Karma: 1
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 601


try God....... believe in yourself.


View Profile
« Reply #43 on: November 12, 2010, 19:49:04 PM »

hey! see o, e be like say gago don understand say na him be the goat o o, see as he they imagine himself becoming suya.  so hadaek go become chicken  & who go come shop who na?
Logged

Any student that has just been addmited into med-lab or any oda dept in health/medical sci.  Who needs my assistance should pm me his no so he wil mine. U'r all welcom.
mac-blend
Sr. Member
****

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 316


View Profile
« Reply #44 on: November 12, 2010, 22:04:47 PM »

Dat 1 u fit guess na. Ak go summarize dem al. Bt mayb him go helep mata. Make we dey watch. 
Logged

The reason u can't b me,is simply d reason i can't b u.
ejibond
It is not by my power. Greatest
Global Moderator
Award Winning Member
*****

Karma: 4
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 2405


ONE LOVE!!


View Profile
« Reply #45 on: November 18, 2010, 20:44:59 PM »

    THE GOLDEN JUBILEE Episode 11

Wako: wait o! sebi u say u don die abi?

Gago: yes naww! i don die patapata 4 dis kind work..

Wako: veli gud...since as u say u don die 4 d work,na im b say dis bomb delivry wey we wan do go fit u weeelll well..

Gago: wetin u mean?

Wako: well,as u say u don die,na im b say na ur ghost we dey c so and u knw say ghost no dey die...so even if u cari d bomb go abuja and d tin blast u 4 road,u no go die again cos u don die already..

Sambo: hahaha..yes o! maybe na gago go deliva all d two gift y me go dey watch...

Gago: c ur mouth like watch! say i talk say i don die no mean say i don die...wetin i mean bsay d job no b small one atall and b4 i go fit do d job well, i must act like james bond 4 dis mision....

Ak: luk...if u like act like james bond,if u like act like john bond,e no concern me atall...my own be say make u & sambo make sure say una do una work fine fine witout prblm...

Sambo: oga dat wan no go b prblm atall...

Wako: but oga! How we go take announce am make no bodi go d parti?

Ak: eemm we go talk am for radio & tv so dat pple go hearam

Headek: eemm! dat radio gud o but i no tink say e beta if na we go talk am 4 radio.

Ak: y naa?

Headek: na bcos, if dem knw say na we wan scarta d parti,dem go hamma us 4 jail one time,whch means say our plan don fail b dat...

Wako: kai...oga na true headiko talk ooo..

Ak: so how make we do am?

Headek: eemm! e get wan aboki man wey i dey always c..we fit bribe am wit moni make he help us do d talking 4 radio...

Ak: correct!...u b correct guy..!

Gago: hmmm..oga me i no support dis wan wey headiko dey yarn so..

Ak: shoo! y u no support am na?

Gago: y we go bribe aboki to help us talk 4 radio?

Headek: but na d only way d aboki go fit gree na..

Gago: abeg liv dat wan wey u dey yarn...i knw aboki dem,all abokis too like radio...if we ask dem to talk 4 radio 4 us dem go do am sharp sharp witout kolect any moni frm us

Wako: u mean am?

Gago; yes naww...make una no mind dis headiko atall o,na moni wey he go take shack brukutu & ogogoro he dey find so

Headek: gago, shey ur madnes don start again? Shey u smoke weed b4 u com dis meetin?..i dey ask u!

Gago: c dis zombie o! so u don get liva 2 dey talk to me anyhw abi...e bi lyke say u don 4get wetin i do u dat last time wey u dear d lion wey dey slip?

Headek: make thunda faya dat ya smellin mout 4 dere..u tink say i dey fear u,who u be sef!?..who born u!?

To be continued...
Logged

Cleanliness is next to godliness.How clean is ur heart?....clickHERE
mac-blend
Sr. Member
****

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 316


View Profile
« Reply #46 on: November 18, 2010, 21:33:23 PM »

Hmmm! Na wa 4 gago n headek. Dis two na real wahala b thier name.
Logged

The reason u can't b me,is simply d reason i can't b u.
Prince Justice
I AM A CHOSEN, chosen is blessed
Sr. Member
****

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 458


Seek God First, and evry oda tin shal follow


View Profile
« Reply #47 on: November 19, 2010, 00:01:36 AM »

Ejibond you no go crack person ribs.
Logged

Remember one day you will leave this world,where will your final & enternal destination be?

Heaven or Hell?
>The choice is yours<
Prince Justice
I AM A CHOSEN, chosen is blessed
Sr. Member
****

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 458


Seek God First, and evry oda tin shal follow


View Profile
« Reply #48 on: November 19, 2010, 00:02:02 AM »

Ejibond you no go fracture person ribs.
Logged

Remember one day you will leave this world,where will your final & enternal destination be?

Heaven or Hell?
>The choice is yours<
machina
Hero Member
*****

Karma: 1
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 601


try God....... believe in yourself.


View Profile
« Reply #49 on: November 19, 2010, 21:03:05 PM »

hahahahaha...! this two guys self, why them never want fight since? na so so mouth dem get die......
Logged

Any student that has just been addmited into med-lab or any oda dept in health/medical sci.  Who needs my assistance should pm me his no so he wil mine. U'r all welcom.
Ijecs
Full Member
***

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Female
Posts: 166


View Profile
« Reply #50 on: November 21, 2010, 21:58:04 PM »

 Eji, abeg carry go!
Logged
Prince Justice
I AM A CHOSEN, chosen is blessed
Sr. Member
****

Karma: 0
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 458


Seek God First, and evry oda tin shal follow


View Profile
« Reply #51 on: November 24, 2010, 18:19:24 PM »

oboy wetin dey happen drop one to ease the tension...............
Logged

Remember one day you will leave this world,where will your final & enternal destination be?

Heaven or Hell?
>The choice is yours<
adim2
The Wisest
Global Moderator
Award Winning Member
*****

Karma: -3
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 1236


View Profile
« Reply #52 on: December 11, 2010, 02:51:45 AM »

i'v missed d joke section vry much
Logged

Break every commandment. But don't break the 11 commandment
ejibond
It is not by my power. Greatest
Global Moderator
Award Winning Member
*****

Karma: 4
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 2405


ONE LOVE!!


View Profile
« Reply #53 on: December 19, 2010, 02:31:24 AM »

sorry for d delay....i go carry on...
Logged

Cleanliness is next to godliness.How clean is ur heart?....clickHERE
adim2
The Wisest
Global Moderator
Award Winning Member
*****

Karma: -3
Offline Offline

Gender: Male
Posts: 1236


View Profile
« Reply #54 on: December 19, 2010, 02:41:46 AM »

k
Logged

Break every commandment. But don't break the 11 commandment
Pages: 1 2 [3]   Go Up
Print
UNIVERSITY OF NIGERIA COMMUNITY | GENERAL COMMUNITY | General Discussions | Jokes | Topic: Jokes Entertainment Cinema!!
Jump to:  

Powered by SMF 1.1.15 | SMF © 2011, Simple Machines
SMFAds for Free Forums